Bulletin
Shakespeare Sonnet 9 for Naijá
"Na say person dey fear make water no run comot for widow eye,"
"Na im make you carry body for corner like sey you tire for life?"
"Eh! If you no born pikin before you die,"
"Everybody go begin cry as de dey do when yeye wife die;"
"Everybody go come become widow for you and begin cry"
"Sey you die no born pikin,"
"When e suppose be normal normal sey woman wey e husband die"
"Na e pikin dem e take dey remember e husband wey don die:"
"Chai, na correct bad market o"
"For dat kain man, because everybody go dey jolly jolly dey go;"
"Sha e go be sey fine woman come life come waste e beauty,"
"Take e hand spoil as e fine reach."
"E mean sey for inside e belle love no fit come outside"
"Sake of sey im life be as person wey e comot house go shit for church."

Naijá Dictionary

Number one Nigerian Pidgin Dictionary

How to get it? If you wan buy/order, call or send message for Whatsapp to dis number:+2348 166 550 860. Get an Invoice here also: Invoice

How di Matter take start

Nigerian Pidgin as e be for global, local, and oder levels

For many years wey don pass, we see sey many different people dey use Nigerian Pidgin do different correct tings, according to wetin deir level, interest and work be. We dey see as dem dey use am for comedy, music, advertisement, politics, social media and oder area. Na dis one make us reason am sey make we do Joinbody Meeting to gader people for the different schools and workingplace for Nigeria, our people wey dey for abroad, and Africa countripeople to yarn pidgin and see how far di language don go, how people take dey use am for abroad, and how de dey use am run tings ontop different levels.

Pidgin na di only language wey dey join all Nigeria countrypeople togeder as one. Di main yarning wey dey announce di Joinbody Meeting na: ‘Naijá na Hẹlẹlẹ- Nigerian Pidgin as e be for global, local, and oder levels. The Joinbody Meeting go bring many different sabipeople, television people, radio people, newspaper people, actor, singers, and oder people togeder to yarn, learn from eachoder and jollyjolly ontop pidgin matter.

Go look di themes

Ogbonge People Recording for Naijá

Former President, Goodluck Jonathan. Go watch am

President Emmanuel Macron. Go watch am

King Charles III. Go watch am
"Naijá na really hẹlẹlẹ"

  • Naija Symposium Go watch am
  • Claire Edun (Oyinbo Princess) Go watch am
  • Fari Elysian Go watch am
  • BBC Pidgin land for Nigeria Go watch am
  • Amadou Elizabeth Aminata (a.k.a A.I. JARVIS) Go Look
  • If Say I be Spoken Word Poet Go watch am
  • Colgate - Drumroll: The Yanga with your smile Go watch am
  • Yellow Card: Go look movie wey dey do for Pidgin Go look
  • Shake the Sword
  • Nigerian Shakespeares: Naijá, English, Yoruba & more - Listen Here