000

Days

00

Hours

00

Minutes

00

Seconds

Wetin make us wan do di Joinbody Meeting?

For many years wey don pass, we see am sey many different people dey use Nigerian Pidgin on dia own take do different correct tings as we dey see am for comedy, music, advertisement, politics, social media and oder area. Na dis one make we reason am sey all di whole people for di different professions for Nigeria, our people wey don travel out, people wey dey oder parts of Africa and di oder countries for di world suppose joinbody to see how di language leg go strong pass as e be now for how we dey take use am for inside our country, how people take dey use am for obodo, and dey use am run tings ontop different levels.

01

  • Talk talk (tok tok)
  • Small joinbody meeting wey dey happen di same time
  • Di Koko yarnings
  • Drama, Tori for Pidgin, Poetry/Wording, Singing, etc.
  • 02

  • Kolabo
  • Connect
  • 03

  • Naijá Festival
  • #

    Professor Francis Egbokhare

    I glad wellwell to call una come di Joinbody Meeting wey we dey do for October 2024. Dis time follow di Independence of Nigeria wey be for October 1. Pidgin na di only language wey dey join all Nigeria countrypeople togeder as one. Di main yarning wey dey announce di Joinbody Meeting na: ‘Naijá na Hẹlẹlẹ- Nigerian Pidgin as e be for global, local, and oder levels. Di Joinbody Meeting go bring many different sabipeople, television people, radio people, newspaper people, actor, singers, and oder people togeder to yarn, learn from eachoder and jollyjolly ontop pidgin matter. Di date na, October 2 go reach October 5, 2024 (Na Independence Week for Nigeria).

    Sabipeople wey go do Di Koko-yarnings

    Emmett Strickland

    Emmett Strickland dey year tiree for PhD program for Paris Nanterre University. Im PhD research work dey look inside plenty Naija word wey dem gader togeder for one place wey de dey call corpus. E wan sabi how the part of di sound of Naija wey dem dey call Prosody and di grammar of Naija dey take mingle. One of di area wey Emmet don help make Naija grow na di NaijaSynCor-Prosody treebank wey e develop. Even sef e help oversee as dem take make di NaijaTTS wey be di first platform wey dey make artificial talk wey dem dey call speech synthesis for Naija. Na since 2019 e don dey do Naija work, dis na di time wey e join French National Research Agency project, NaijaSynCor.

    Christine I. Ofulue

    Christine I. Ofulue na Professor of Linguistics and sabiperson for Distance Learning for di National Open University for Nigeria. She do her PhD for Indiana University, Bloomington, USA (1992). She do Postgraduate Diploma for Open and Distance Learning for Indira Gandhi University, India (2008). She don talk for many local and joinbody meeting for Nigeria and abroad as di person wey get di kokoword. One of dem na for Society for Pidgin and Creole Linguistics (SPCL) Summer joinbody meeting for di University of Groningen, Netherlands for 2023. Di part wey concern am pass na how many languages and technology dey mingle to affect how people dey select and use language for society wey many different languages dey togeder. She dey work on Naija (Nigerian Pidgin) and minority language and deir levels. She also dey work on Africa people wey dey abroad, put eye for wetin join Nigerian Pidgin, Gullah, and African American Vernacular English and how dem different. She be one of dose wey join work for NaijaSynCor project, wey gader Naija word togeder for wetin dem dey call Corpus. Ofulue na di Director for Regional Training and Research Institute for Distance and Open Learning (RETRIDOL) for di whole West Africa and Director for di African Council for Distance Education Quality Assurance and Accreditation (ACDE QAAA).

    Di Joinbody Meeting timetable

    Our Kolabo People